"Wen you dey hear sounds of sirens all fi time and see pictures of schools, hospitals and houses wey don scata, how you go normal? "E dey make me sick to see dead bodies and burnt houses. Dis Ramadan dey full of pain," na wetin Niyara Mamutova yok. Israeli forces raid Al-Aqsa mosque, injure ova 150 Palestinians. Why Russia ban UK Boris Johnson, senior ministers - Niyara na ethnic Tatar wey run from Crimea for 2014 and anoda Ukrainian Muslim woman from Kyiv, Viktoria Nesterenko gree with am. Dem tell BBC how dem dey cope with observing Ramadan inside war.
